I Wish I Had A Better Family Relationship 

When I see my friends and their siblings, their friendship, fights, and support, I ask myself if my life would’ve been easier with just a bit of that family relationship. Na only me dey call you, no problem. The only time you dey remember say I dey exist na if you wan send me a message or scold me, no problem. Man, I nor dey follow wayward life, I nor dey live. I dey struggle for myself; the day wey work come, I go do. If hunger dey tear my belle, I nor dey bother anybody. This time wey work sef nor dey come again for these past few weeks; na the small funds wey dey my hand I take dey guide. Cost of feeding don too much.

I dey hear things wey you dey do for extended family wey nor send you o; now I dey hear say you send 7 figures to these same people wey nor care whether you dey exist, but your own blood dey starve. Those ones dey feel say me dey enjoy based on last born, but I nor fit tell dem how e dey be. I nor ask for food because you nor go give; I nor ask for clothes because you nor go buy me; help for my business nai I beg you. Mama nor be so o. I’m not angry at you, though, sister. I’m really tired of doing it all alone without you. I wish I could talk to you about my worries aside from money too. Relationship, friendship, and the likes because nothing is working for me at this point.

Also Read: Vision About My Life

error: Content is protected !!