I greet the house oh. I no go lie oh, I be old taker, and my life is currently in that stage that you’re like let me just end it all. E no get any shege wey I never see, financially, emotionally, mental health, family expectations, because when e been dey, I dey do well well before. Not that they are pressuring me or anything oh, sometimes my parents and siblings dey send me money sef because they have my account, but me I still dey feel that kind feeling. I’m sure some guys will understand. Even friends too dey snitch on me now.
My relationship sef is shit now because I no fit please my babe again. She said I will have to do what she wants first before we will continue dating again, sha I offended her too though. Even my internet work too is not working how I want it to be or how it used to be. So right now I don’t know what else to do anymore. Nobody has to tell me, I know I’m depressed af right now. I’m still optimistic everything will still go well for me and I’ll be okay again, but right now it’s not just it.
Also Read: Gifting My Girl Gone Wrong
Drop a comment