No Relationship, No Social Life, But at Least I Open Gates

Omohhhh, I just need to rant, abeg. Staying at home don open my eyes to things I no suppose dey see. When I first moved in, I was enjoying my space, but now? I can’t take it anymore. Make I no go run mad oh! Honestly, I for just calm down and collect self-con that time, but my ex-roommate wahala too much, so I ran for my life. Unfortunately, I didn’t get a proper student hostel, so I landed in this face-me-I-slap-you compound. As an introvert, I’m always indoors. My classes were mostly virtual, so my social life don kpai. Meanwhile, everybody else in this house gets a life but me. They always waka up and down, whether for work or just vibes. Now, here’s where it gets funny—I don turn customer care rep for house. They knock my door to ask, “When NEPA take light?” “Open gate for me.” “Good morning!” like say dem dey sign attendance. “You never go out?” Early morning, dem go dey call my name like roll call, just to tell me they are going out.

Please oh, somebody should help me before they promote me to Chief Security Officer. If dem dey outside, na me dem go call, “Please help us open gate.” If NEPA take light, na me dem go con meet say, “How e happen?” Even “good morning” don turn salary wey I must collect daily like say na work. Omoh, oti su mi oh! To make it worse, my boyfriend stays in another state, and I don’t have friends. The last one I had (my ex-roommate) use my eye see shege. Ilorin is stressing me out! Somebody help me, abeg. How do I find real and genuine friends? At least somewhere to go sef. I need to start stepping out because four years in Ilorin, and the only places I know here are Tanke and Post Office. Kai, abeg, fine girl don almost turn Chief Security Officer. Na wa oh!

Also Read: Couple goals: Lies, Deceit & 7 Congo of Rice

error: Content is protected !!