My guy dey date one girl about one year ago, so along the line my guy gave this babe my number as per friends nah. After a few months, dem breakup. This babe dey message me, call, and stuff but I no give her face. So last month sha, after one year, I told her to come visit, so she came and we knack, but the girl toto don make gbim. I come use style follow my guy talk say why e leave the girl, my guy said he no feel anything when he dey knack am and the girl na just 22. The girl dey gaslight me say my prick too big. Meanwhile, I no too feel anything when I dey knack am but normal I get big prick.
My guy new girlfriend don dey do video call with me and truth be told, I’ve never message her before but she dey streak me, dey send me her daily routine. In fact, the last time she called, it lasted for about one hour plus and I don’t know how to cut her off. I no wan disappoint this my guy make I no knack this one too. My guy dey always talk say I get big prick. I no sabi if he don tell all his present girlfriends too. Please judge me, I feel I’m doing something bad because I might knack this girl too with the way it’s going.
Also Read: The Deceitful Dream: A Call To Action Against Human Trafficking
Drop a comment