Being a Man is Not Easy

Omo, men dey try. No work, no hope for this useless country. A day, I spend at least N6k for food, and na manage. If I say make I enjoy myself small, I go don spend N30k. Annoying part—no be better food. How I take dey survive dey surprise me. All my friends that we school together don cash out well. I no follow do yahoo as a good boy, dem leave me for back. Na the biggest mistake of my life say I want clean money. No clean money for this country, I swear. Last year December, I start yahoo, I no see better thing cash out. Just N1.2m wey don finish. I dey run my spill. After graduation, to see work na problem. I no blame people wey dey do ritual sha. Make God no allow us do bad thing. Annoying thing—I dey turn 25 this June with nothing to my name.

Also Read: Marriage & Visa Issues

error: Content is protected !!