Don’t Go For Stingy Girls

All these boys shouting “I need a rich babe, wey her papa guide?” Omor, na una go still sponsor their lavish lifestyle. Those girls—na them beg pass, but to press money hard dem. Na so I ask my babe make she help me with N2k, she say she no get. But she dey always post trading chart. POV: I always spoil her, no cap. But omor, leave am—girls stingy die. Common thing as 2k. Not like I no get am o, na stupid network misbehave. I gat DM my babe based on say I think say she follow guide without her papa money too because she dey post forex chart up and down. Abi na demo account? Omor, guys make una go for girls wey no stingy o. No be to get papa wey guide oh—you on your own, you guide? Abeg, I don go back go meet Nkechi wey na hustler.

Also read: I keep Seeing Her In My Dreams

 

error: Content is protected !!